Children Of God Will Prevail In Tough Times
Some exile Jews return home to rebuild dea homeland, but di enemies dey furious about dea decision, and dem dey willing to do whatever it take to stop dem. However, Israelites summon kourage to resist dea opponent and keet dea project to schedule. Besides, di determine Jews push back against di enemies with applicable legal backing. Di responsible authority honor dea petition, and God name dey glorified. E dey reported, “…Therefore, if e please di king, we request sey we search fo di royal archives of Babylon to discover whether King Cyrus ever issue decree to rebuild God Temple fo Jerusalem. And den let di king send us hin decision fo dis matter… So King Darius issue orders sey make dem search fo di Babylonian archives, weh dey stored fo di treasury. But e dey fo di fortress fo Ecbatanain di province of Media wea dem found a scroll. This is what it said: “Memorandum: “fo di first year of King Cyrus reign, dey send a decree out koncerning God temple fo Jerusalem. “Make dem rebuild di Temple fo di site wea Jews used to offer dea sacrifice, using original foundations. Hin height go be ninety feet, and hin width go be ninety feet. (Ezra 5:17; Ezra 6:1-3).
Since Israelites remain persistent sey make dem rebuild God temple, God help dem. With all di waala dem face, Israelites dey able to successfully build God temple. Dem decorate am and offer acceptable sacrifice to God.
LESSON
Pipu weh serve God no go regret dea decisions, but dem go get honor fo dea pious efforts. Although God pikin dem fit go through tough times and harsh circumstances, but dem go ultimately prevail. Dem go scale through dea challenge to praise name of God. Godly pipu go obtain many benefits, therefore everyone suppose endeavor to associate with God and serve Am well to enjoy these benefits.
PRAYER
Dear God, i beg make me be pesin weh love you wholeheartedly so that i fit triumph in every aspect of life. I understand sey you go defend those weh honor you, and you go disallow dea enemies to mock dem so that your name fit be praised fo dea behalves. I beg strengthen me to work well with you to enjoy all your benefits. Fo in Oga Jesus Krist name i make my requests. Amen.
