Complete Safety Na From Oga God
No pesin fit guarantee perfect security, except Oga God. Any security measures wey human being provide go remain inkomplete, and no fit stop unwanted cirkumstansis. To talk am well-well, di skripture tok am say,
“Just as di plenty sojas wey king get nor go fit save am, Na so too pesin pawa nor go fit save am. So make yu nor feel sey na yor shariot go make yu win, bikos with all en strent, e nor go fit save yu.” (Psalm 33:16-17).
LESSON:
Perfect sekurity comes from Oga God, and bilivas of Oga Jesus get dia share in it. Oga God go remain koncerned for hin pikin and he go kip dem safe onda hin watchful eyes. Howeva, pipol wey kip dia trust in di arms of flesh go dey disappointed. Since, di knowledge of human dey limited, dere no go be total sekurity guarantee by anyone. (On di oda hand, sekurity from man dey kostly!) Oga God sure sekurity ova hin shidren go last for life. To dey qualify for di proteson of Oga God, a pesin most to don konfes Oga Jesus Krist as hin personal Lord kon show God fear in all tins wey he dey do.
PRAYER:
Oga God, abeg I nid your sekurity wey dey gidigba ova my life. Now, I humbly konfes my sins kon repent from dem. I also konfes your Son Oga Jesus Krist as Lord, and I accept him as my personal Savior. Abeg establish my feet as your true shaid who go dey enjoy your sekurity and oda benefits for life. The koko be say, abeg write my name in di book of life, so dat I go dey accepted to your heavenly kindom. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
