Di Righteous Go Dey Blessed
Di promises of Oga God stand gidigba on anyone wey faithfully serve him. Di skripture talk the fact wen he talk say,
“But doz wey dey fear God, go prosper like bambo tree And dem go strong as dem dey grow like cedar tree for Lebanon.Bikos God don plant dem for en house, dem go grow well. Dem go still dey produce fruit for old age! Dem go dey strong and fresh well-well.” (Psalm 92:12-14).
LESSON:
Pesin wey serve God witout mago-mago get notin wey he go lose, but h go have evri good tin to gain. Di more we serve Oga God, di beta our lives go bekom. Di kreator go open doors of opportunity for us, and he go spoil us wit hin goodness. Unbilivas go see hin blessin and go dey motivated to serve Oga God too.
PRAYER:
Oga God, abeg give me grace to faithfully serve you always so dat I go fit qualify for your blessins. Let your benefits dey for my life, so dat all pipol go testify to your goodness. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen
