Emulate Jesus In Every Way
Bible require God pikin to walk with dignity and honor. We are to dey practice plain kristianity and dey avoid irrelevant arguments weh get little or no kontribution to our spiritual growth. Di bible talk am,
"Make you Avoid foolish disputes, genealogies, kontentions, and strivings about di law; Because dem no dey profitable and dem dey useless. Reject divisive man after first and second admonition, knowing sey such a person na warped and sinning, being self-condemn” (Titus 3:9-11).
LESSON:
Followers of Jesus Krist suppose to resemble Jesus Christ. Believers must get discipline and demonstrate honorable posture, since God Himself get discipline. Our speech and actions must prove sey Krist dey live inside us fo real. Our life must dey konsistent with di bible, and we must dey firm to uphold God standard of righteousness. We kristians must dey konsistent with our profession of faith! Heaven require sey make we avoid unnecessary arguments, but make we celebrate sound bible doctrines.
However, Jesus Krist follows must understand di importance of demonstrating kristianity with grace! Believers must dey operate inside love and grace; we must to dey love, and we must accommodate other pipu (without sey make we dey compromise bible standard). God expects Hin pikin to dey glorify Hin name fo every aspect of dea life, and we must do dey am!
PRAYER:
Dear God, I beg make my life dey konsistent with your standard. Help me to practice true kristian so that your name go fit be glorified fo all situations! Empawa me through your Holy Spirit to dey walk in righteousness. Make my yea be yea, and my nay be nay - according to bible standard. I beg shine your light to my life, and allow me to dey spread di same light to other pipu. I beg make me your true ambassador fo dis earth, so that I go dey qualify fo your heaven reward. Fo in Oga Jesus Krist name i make my requests. Amen.
