Fellowshipping In Oga God Loves
An act of wickedness na abominason to Oga God, and he go punish it. No wiked person go go free witout say he dey ponished – unless say he repent. Di skripture talk am wiked pesin,
“…Like lion wey hide for korna, Na so dem dey wait to kill innocent pipol. Dem dey katch and drag innocent pipol for dia net like hunta wey katch animal. Dem dey kill pipol wey nor get pesin wey go help dem; Doz wey nor get pawa rish dem. Wiked pipol dey sey, “God nor dey si us! E don klose en eye and E nor go even fit si wetin wi dey do” (Psalms 10:9-11).
LESSON:
Nemesis go catch up wit wiked pipol - unless say dey repent. God will measure dia evil acts kon rewod dem accordingly. Since, di kreator dey pawaful, his jodgement ova wiked pipol go plenti m So, all pipol most to have di fear of God and dey do justice m Jehovah go bless pipol wey treat odas well, wey dey show konfam love.
PRAYER:
Oga God, I no wan be wiked pesin; so, abeg help me to dey just and show true love to odas. Let me use watevea opportunity I get to bless odas and glorifying your name. Let your Holy Spirit give me pawa to remain your faithful shaid for all di days of my life. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen
