God dey kount on you
Queen Esther must use her influence to save Jewish pipu from Mr. Haman weh don vouched to destroy dem. Mordecai go meet Esther and challenge am to use her rare God-given opportunity to save her pipu. Esther must not fail, Mordecai warn am. He say, “Because if you remain completely silent fo this time, relief and deliverance go arise fo Jews from another place, but you and your papa house go perish. Yet who know whether you come to di kingdom fo dis kind time?” (Esther 4:14).
LESSON
Kristian must remember to honor God with their position since Hin dey kount on dem. As Hin trusted servants, we (believers) must do anything with pawa to satisfy God will. The Kreator go dey happy to see sey we no fail Am because Him go bless us in return. However, He get replacements fo insolent pikin, He go displace people weh dare to disobey Am, and replace dem with better choice. Therefore, all kristians must give due honor to God and serve Am with best effort.
PRAYER
Dear God, i beg help me to serve you well and give you due honor. Make you no make me take you fo granted and make i no abuse my opportunity. Help me to utilize my God-given grace to bolster efforts weh go glorify your name fo every ramification of life. I beg no make me fail you so that i fit dey worthy of your blessing always. Fo in Oga Jesus Krist name i make my requests. Amen.
