God Is Inestimable, He Get Pawa Ova All Tins
A Syrian king and hin army lower di value of di pawa of God and believed say dem fit attack Hin protective pawa. Afta all local gods(idols) don fail. To give dem viktory in dea batu against di Israelites, di Syrians kon tok say God wey sopot di Israelites must to dey pawaful on di hill side wey dem fight di batu. So, he tok say he go attack di Israelites on an ordinary land. Howeva, dey lost dea batu to di Israelites also. Di bible tok say, “ King Ben-Hadad ofisas kon tell am, “Na gods fo mountin bi Israel pipu gods, naim make dem fit win us. But wi go win dem, if wi fight dem fo ordinary groun.” “One profet go meet King Ahab kon sey, “Dis na wetin God tok: ‘Bikos Siria pipu tok sey I bi god fo mountin and nor bi fo groun, I go make you win dea many sojas and you and your pipu go know sey na mi bi God. ” (1 King 20:23; 1 Kings 20:28).
LESSON
Oga God no dey limited in pawa; anybodi wey ridicule di pawa of Oga God go live to regret am. Oga God pawa dey unlimited, He get di knowledge of evritin. Nobodi fit win am and He no dey tire! Di pawa of Oga God pass any pawa wey dey exist. God be Jehovah, and He be di kreator. He born, kreate all tins di way He want. Oga God get di right ownership of evritin wey dey exist – whether dey don diskova am or dem neva diskova am! Oga God dey rule di whole world, and He be pawaful pesin wey nobodi must to disrespect. All kreatures must to serve Oga God, and evrione must to give him di honor wey hin sopos get evri time.
PRAYER
Oga God, I honor you bekos you be di King of kings and Lord of lord. Your pawa dey great and your dominion dey konvicing. I love you and I owe my allegiance to you. Notin go make me serve an idol, and notin go make me use you kompare anoda pesin. You be my Lord, strength, and my konfidens. You be my testimoni, and you be di the reason wey I dey live! My loyalty go remain wit you, and my assorans of salvason thru your Son Oga Jesus Krist go neva fail. Fo I konfam my konfidens and loyalty to you thru your only Son wey be Oga Jesus Krist. Amen.
