God Will Defend His Servants
Judah authority punish Jeremiah sey because he speak out God mind. Dem throw am into a pit with di hope of starving am to death. Di bible report am,
“So dem take Jeremiah and cast am into dungeon of Malchiah di king son, it happen fo di court of prison, and dem let Jeremiah down with ropes. And water nodey in di dungeon, but mire. So Jeremiah sink in di mire” (Jeremiah 38:6).
LESSON:
We live fo di world wea people show little respect fo God, and dem go abuse God servants to hurt God. God servant dey often abuse; misunderstand, and misrepresent. Meanwhile, Jehovah no fit dey happy with those weh abuse Hin servants. Since dem bi Hin oracle, God go defend hin servants! Pipu weh abuse dem go get so much konsequence to pay fo! Instead of irrational behaviors towards God servants, pipu fit choose to understand dea tasks and honor dem.
God servants bi God oracles; dem speak God mind. God servants bin expect to tell truth of di bible always, and pipu are expected to follow dea lead. God servants dey answerable to God, dem no dey answerable to us - and make we no take dem fo granted! Make we no harass God servants because because dem dey performe dea role; instead, make we follow dea instruction. E dey important sey we honor God servants since dem dey represent God; whatsoever we do to dem nah wetin we don technically do to God Himsef. Person weh expect some benefits from God no suppose attempt to dishonor Hin servants!
PRAYER:
Dear God, I understand sey e dey disastrous to dishonor your servants. You go punish anyone weh abuse pipu weh you don kommission with special assignment. Fo dis reason, I dey determine to start to dey honor your servants. I dey sorry fo how i don mishandle your servants before before. From dis time, I go dey honor your servant. I go support dem fo any kapacity so that dem fit dey motivated to kontinue to dey serve you in good
spirit. I beg give me grace to start to dey do things right! At the same time, I dey use dis opportunity to pray fo your servants throughout di world, sey you go anoint dem with grace to kontinue to dey serve you. Give dem energy to kontinue to dey obey you, and make dem prosper in all dea ways - so that your name fit be praise fo dea lives. For in Oga Jesus Krist name i make my requests. Amen.
