Notin Fit Replace Holiness
Oga Jesus Krist warn his pikin wey dey folow am make dem dey fokus kon dey redi for di rapso. Di messiah talk say, “So, make una shine una eye! Nor let party and wahala for dis life full una mind, if not, dat Day go kom wen una nor espect, bikos dat Day go sopraiz evribody wey dey for dis world. But make una dey shine una eye evritime, dey pray make God give una pawa take pass all dis test wey go happen, so dat una go fit stand for Man Pikin front.” (Luke 21:34-36).
LESSON
Di world system don dey programmed to get pipu fill wit eartly tins wey go porsu dem from serving Oga God faithfully. Shallenges dey here and dere; bills most dey paid, and oda tins wey fit pressure us go dey kom up. But, Kristen most to dey kareful so anitin no go affect dia relationship wit Oga God. Whether di world like am or not, rapso go hapun and Oga Jesus go karri hin saints to heaven. Anybodi wey dey behind go sofa for satan hand. So, all piou most to dey redi to return wit Oga Jesus Krist weneva he appear in di sky.
PRAYER
Notin upon notin, di world na notin! I don talk say I go dey folow Oga Jesus Krist and I no go allow any situasen to stop me from him. I don made up my mind to dey kip di testimoni ad a shaid of God. I stand wit wetin I talk, and I go hold my konfeson of Oga Jesus Krist to di end well-well. Yes, Oga Jesus Krist na di true and di only Son of God wey he send to save di sinas wey lost Since I bilive in Oga Jesus, my sins don dey forgiven and I don qualify for rapso! Oga Jesus Krist na my personal Lord and Savior, and di devil no fot do anitin to stop am. My faith dey in di Son of Oga God foreva! Amen!
