Oga God Dey Fearful In Praise
Oga God dey known for promoting justice, and his name dey praised for showing goodness to humanity. Di skripture tok am well-well,
“God na king! Make di eart happy! Make river and sea happy too. Dark kloud dey round am. Na to do rite and judge well, bi di foundashon for en throne. Fire dey round God for front and E burn all en enemies for evry side. En tonda lite dey shine round di eart, So wen di eart si am, e kon dey shake. Di mountins dey melt like butterwen dem si God wey get di whole eart. Di heavens dey tok about en raitiousness; evribody dey si en glory.” (Psalm 97:1-6).
LESSON:
We Christians nid to always praise God for all hin goodness in our lives. If we remember his goodness, we go see say di kreator don do so many mirakus for our lives and in di lives of our loved ones. Howeva, di mirakus of God no get limit, he go still do more new mirakus if we kontinue to praise and trust him.
PRAYER:
Oga God, abeg let my mouth dey filled with your praises. Give me ability to remember your goodness in my life, and let my testimoni turn into motivason for serving you more. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen
