People Pleaser
Kristians must focus dea efforts on activities weh go glorify God. Our efforts no suppose focus on receiving human praise, and e no suppose be for any other selfish reason. Jesus Krist say, “Fo dis reason, wen you do charitable deed, make you no sound a trumpet before you as di hypocrites do fo synagogues and fo streets, so that dem fit get glory from men. Assuredly, I tell you, dem get dea reward. But wen you do charitable deed, make you no let your left hand know wetin your right hand dey do, that your charitable deed fit be in secret; and your papa weh sees in secret go Himself reward you openly. (Matthew 6:2-4).
LESSON
God respects true worshipers, but Hin dishonors pipu pleaser! Di Kreator expects Hin pikin to give Am honest service without self-seeking glory or human praise. In addition, God pikin must not engage inside false humility to gain approval from others. We are expected to bi pure fo God front and give Am our best service as empawa by Holy Spirit. Di Kreator go reciprocate our efforts with blessing so that we fit dey motivated to serve Am more.
PRAYER
Dear God, i beg help me make i offer you my activities with holiness. Help me make i offer selfless service to you. Make i no serve you to receive human praise, but make my activities dey selfless to glory your Holy Name. Make my service be worthy of your blessing fo this life and fo heaven also. Fo in Oga Jesus Krist name i make my requests. Amen.
