Servants Of God Need To Be Disciplined
God servant suppose dey firm with dea bible interpretation. Dem must to dey call spade spade, and make sure sey dem dey talk di truth from di altar. Weda e dey konvenient or e no dey, God servants must dey tell di truth so that pipu fit know wetin God require from dem. God warn Prophet Ezekiel fo di danger looming over am and hin pipu if he refuse to speak God mind as hin suppose speak am. God warn Ezekiel and Hin say,
“Man pikin, I don make watchman go you,fo Israel house; fo dis reason hear word from My mouth, and make you give dem warning from Me: Wen I say to di wicked, ‘You go surely die,’ and you no give am warning,and no speak to warn di wicked from hin wicked way, to safe hin life, that same wicked man go die in hin iniquity; but I go ask fo hin blood from your hand. Yet, if you warn di wicked, and hin no turn from hin wickedness,and from hin wicked way, He go die fo hin iniquity; but you ron deliver your own soul. “Again, wen one righteous man turns from hin righteousness and commits iniquity, and I lay stumbling block before am, he go die; because you no give am warning, he go die fo hin sin, and hin righteousness weh hin hin do no go dey remember; but i go ask hin blood to your hand. Nevertheless if you warn di righteous man say make di righteous man no sin, and he no sin, he go surely live because he took warning; also you don deliver your own soul” (Ezekiel 3:17-21).
LESSON:
God servants bi Hin treasure instruments, and He expects nothing much but discipline from dem. God holds Hin servants with high esteem; dey must appropriately speak Hin mind and make sure sey dem save guide pipu from pitfalls. God servant no get right to serve God at any wish way dem want, but dem dey mandated to meet God standard every times! Honor belongs to a servant weh do hin or her job well, but God punishments loom over a servant weh fail hin Master! Since di kreator dey count on Hin servant to represent Am well, make dem no hesitate to honorably karry out dea due diligence. By so doing, heavy rod of punishments go be averted, and huge positive rewards go be obtained (by God servants, and dea pipu). Kongratulation to those servants wey faithfully serve God, fo dea rewards gol dey obtained on earth, and fo heaven!
PRAYER:
Dear God, i beg make me be true and thorough servant weh go faithfully serve you. Make me dey konsistent with your word, and make me serve you wholeheartedly. Give me strength to speak di truth every time - whether e dey konvenient or e nor dey. Make my talk and wetin i dey do glorify you, so that other pipu fit dey motivated to serve you also. I beg anoint me with fresh ointment to serve you faithfully till end! And also, I pray fo all your ministers weh dey all over di world: i beg give dem strength to serve you with faith. Make your ministers lead by example so that your name go fit be glorified among dea pipu. Fo in Oga Jesus Krist name i make my requests. Amen.
