The Help Of Holy Spirit
Paul pray fo Kristians to have get spirit of unity so that dem fit serve God together with one mind. Paul pray, “Now make di God of patience and komfort grant you to be like-mind toward one another, according to Krist Jesus, that you fit with one mind and one mouth glorify God and Father of our Lord Jesus Krist” (Romans 15:5-6).
LESSON
Kristians need to operate in unity to promote gospel and expand God kingdom. However, e dey almost impossible to achieve this goal among brethren without help of Holy Spirit. Believers need Holy Spirit pass anything else! Di Holy Spirit go help brethren to pursue ultimate goal of satisfying God desires - than satisfying world pressure and craving fo flesh. Therefore, e dey important sey kristian body devote tangible time to seek God face to receive empawament fo di Holy Spirit, and operate under hin divine guidance.
PRAYER
Dear God, i beg baptize kristian kommunity with your Holy Spirit. Make brethren lay down self and pride to submit to each other with love. Make genuine love reign among brethren, so that your light of gospel fit radiate through dem to di world, and unbelievers become save. Fo in your son Jesus Krist name i make my requests. Amen.
