The Secret To Success
Some exile Jews weh return from Babylon to Jerusalem trust di bible fo dea guidance. Dem koncentrated on researching di bible to understand God mind, and also to meet dea expectations. Di bible state am, “…Ezra di priest bring di Law before di assembly of men and women and all weh fit hear with understanding fo first day of di seven month. Den hin read from am in open square that nah in front of di Water Gate from morning until midday, before men and women and those weh fit understand; and the ears of all di pipu dey attentive to di Law book” (Nehemiah 8:2-3).
LESSON
Life achievements dey reserved inside Bible. Anyone weh aspires success must study hin or her bible. Also, bible expose hin readers to understanding God mind and hin requirements. E teach person to learn how to repent from hin sin and live holy life weh God expects. Indeed, lasting success, peace, and prosperity fit only be found in di bible weh bi di word of God. Hence, all God pikin suppose make am dea committed practice to study dea bible to live victorious lives.
PRAYER
Dear God, i beg teach me how to daily study my bible so that i fit dey wise and prosper. Teach me how to apply bible knowledge to my daily activities so that i fit prosper fo all my ways. More importantly, make di knowledge of your word keep me fit to inherit your eternal kingdom. I beg do these things and many more. For in Oga Jesus Krist name i make my requests. Amen.
