Bilivas Dey Adopted Into Di Family of Oga God
We Christians be di heirs of di kindom of God. We no be slaves, but we be sons and dauta of di Most High God wey he don talk say go yake di best place in hin own kindom. We be di konfam shidren of Oga God as di skripture talk am,
“Wetin I mean bi sey, di pesin wey inherit en papa propaty and e still bi small pikin, e nor dey difren from savant, even doh na en get evritin. But e go dey under who dey guide am, until di time wey en papa tok, go rish. Na so e bi with us wen wi small; wi dey under di pawa wey dey kontrol dis world, but wen di rite time rish, God kon send en pikin wey woman born under di law, make e save pipol wey dey under di law, so dat God go make us en own shidren kon give us awa own propaty. Since wi bi God shidren, E put en Holy Spirit inside us and naim make us dey fit koll am, “Abba! Fada!” So, una nor bi slave again, but una don bi God pikin and since una bi God shidren, una go get God propaty too.” (Galatians 4:1-7).
LESSON:
Oga God send him pikin Oga Jesus Krist and di Holy Spirit to konfam day he don accept di christians into his family. So, Christen be Oga God pikin thru dia konfeson of faith in Oga Jesus Krist hin Son Oga Jesus Krist and di Holy Spirit to konfam saybhe don accept di christian into hin own family. Now, christian don dey konfam to be shaid of Oga God thru dia konfeson of faith in Oga Jesus Krist. Bilivas con get chance to di blessin of Oga God. With di use of Oga Jesus name, christian fit komand all tins make dem work well for dem. Di koko be say, bilivas in Oga Jesus Krist be heavenly bound, and dem go receive di crown of glory wey no fit spoil at di end.
PRAYER:
Oga God, I praise your name bekos say you accept me as yur as your son/daughter thru my konfeson of faith in Oga Jesus Krist. I praise you bekos say you change me from di “slave” wey I be to your “son”. Since I don konfes in Oga Jesus Krist, I don turn shaid of Oga God, and my name don dey written in di book of life. Praise Oga God bekos say heaven na my home. I komit my life to you today, tomorrow and foreva. Thank you Oga Jesus Krist for your saving grace. Amen.
