No Abuse Di Grace Of God
Oga God disgraced Sennacherib di king of Assyria bekos say he no respect am and he dey distorb di isrealites. Di wiked king attack Jerusalem wit hin army in an attempt say he wan block di welfare supplies kon overthrow di city. He also write open leta to King Hezekiah of Jerusalem so he go weak am In di leta wey he write, Sennacherib kompare di living God wit small gods kon say,
“Make yu nor let di God wey yu trust fail yu wen E sey, “Assyria king nor go fit seize Jerusalem.” True-true yu don hear wetin Assyria king do to di oda lands. Yu tink sey God go save yu? Where di kountries wey my grand-grand papa dem distroy. Where Gozan, Haran, Rezef and di pipol for Eden for Telassar? Dia gods save dem? Where di kings for Hamat, Arpad, Lair, Sefarvaim, Hena and Ivvah?” (2 Kings 19:10-13). Howeva, Oga God ansa di arrogant King Sennacherib wey challenge him to fight. “For dat nite, God send en angel go kill 185,000 sojas for Assyria kamp. Wen day break, all of dem don die. So King Sennakerib for Assyria run komot from di kamp. E go en house kon stay for Nineveh.
One day as e dey woship en god for Nisrok temple, en sons, Adrammelek and Shareza kon kill-am with dia swod, den dem run go Ararat land. Sennakerib pikin, Esarhaddon kon take-ova as king” (2 Kings 19:35-37).
LESSON:
No pesin fit fight God kon win. Since he be Jehovah, he go do evritin wey he sopos do to protect hin name. So, all pipol most to fear God and honor hin holy name. We most to dey respect him and never kompare him wit any oda idol. Evrione most ondastand say any act of disrespect fit vex God to high price ponishment.
PRAYER:
Oga God, abeg help me wit grace to give you di honor wey you sopos get evri time. No let me disrespect you, but let me dey serve you wit dignity and honor. Let your pawa wey dey supernatural bring me blessin, and let it be well wit me all di days of my life. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
