God Fit Trust You With Riches?
Job (fo bible) bi rich man weh fit be referred as a billionaire of hin time. Di man disallow riches to blindfold am, but he faithfully serve God. Bible describe Job as faithful man weh love God wholeheartedly and serve Am with di best of hin ability. Bible declare about Job, “One man dey in land of Uz, weh hin name nah Job; and that man no get blame and e dey upright, and nah pesin whe fear God and shun evil. And nah seven man and three woman e born. Also, hin possessions nah seven thousand sheep, three thousand kamels, five hundred yoke of oxen, five hundred female donkeys, and very large household, so that this man bi greatest of all di pipu fo di East. And hin sons sons go go feast fo their house, each on hin appointed day, and go send and invite dea three sisters to eat and drink with dem. Ma so e bi until, when days of feasting don run dea course, weh Job go send and sanctify dem, and he go rise early fo morning and offer burnt offerings according to dea number. Because Job say, “My sons dem fit don sin and curse God in dea hearts.” Nah so Job deu do regularly” (Job 1:1-5).
LESSON
God pikin fit be rich and still serve God faithfully. We fit follow Job example (Job 1:1-5) weh serve God faithfully with hin riches. Moreover, e takes humility fo anyone to faithfully serve God with riches. Di person must place God above hin own personal interest. In other words, a kristian weh desire riches suppose first question hin or herself fo subject of trust. He suppose be able to ask, "God fit trust me if I dey rich?" God go surely bless anyone weh determine to serve Am with loyal heart.
PRAYER
Dear God, i beg make me a trustworthy kristian weh dey neither selfish nor obsess of riches. Give me a heart weh konsiders you first and prioritize serving you above my personal interest. Help me to serve you with pure heart so that i fit get opportunity to enjoy your riches fo long time. Fo in Oga Jesus Krist i make my requests. Amen.
