No Dey Anxious About Anything
Jesus instruct Hin followers make dem no worry about anything, but make dem get konfidence in God. Believers must be joyous and hopeful fo all times. We must get expectation sey God promises fo our lives go come to pass. Jesus say, “Therefore I tell you, make you no worry about your life, wetin you go eat or wetin you go drink; nor about your body, wetin you go put on. Shey life nobi more than food and di body more than cloth? Make you see di birds fo air, for dem neither sow nor reap nor gather into barns; yet your Papa fo heaven feeds dem. Shey you no get more value pass dem? Which oonr of una fit add cubit to hin stature as una dey worry so? “So why you dey worry about kloth? Konsider di lilies weh dey field, how dem dey grow: dem neither toil nor spin; and yet I tell you say peven Solomon fo all hin glory no array like one of these. Now if God fit cloth grass fo field, which today is, and tomorrow is throw into di oven, shey Hin no go cloth you more, O you weh get little faith? “Therefore make you no worry, say, ‘Wetin we go chop?’ or ‘Wetin we go drink?’ or ‘Wetin we go wear?’ because nah all these things di Gentiles dey seek. Because your Papa weh dey heaven know sey you need all these things. But make you seek di kingdom of God and Hin righteousness first, and all these things go be added to you. Therefore make you no worry about tomorrow, because tomorrow go worry about hin own things. Sufficient fo di day nah hin own trouble” (Matthew 6:25-34).
LESSON
Pipu weh serve God must no dey anxious of anything, but we must dey hopeful in God. Believer must dey konfident sey God dey ever strong to help us overcome our challenge and lead us to victory. Kristians must understand sey Satan outsource scary situations to challenge our faith. Hin goal nah to make us doubt God and stumble in faith. No kristian suppose give in fo di desire of di enemy. We must dey full of faith and give high expectations. As we demonstrate unwavering faith, God go turn our trials to testimonies, and He go also make Satan be ashame. Indeed, God go kompensate our faith and turn it to testimonies!
PRAYER
Dear God, I beg help me to dey demonstrate unwavering faith in you. Help me to stop to dey worrying about life challenge. Help me to realize sey you dey in charge of my life, and you go perfect whatever koncerns me! As i kontinue to trust you, make my terrible situation turn around to good one, and make me get story of your goodness to share with other believers and di rest of di world. Fo in Oga Jesus Krist name i make my requests. Amen.
