Merci Win Ova Jodgement
Paul and Barnabas separate dia mission once dey don dey see tins differently. But, di two of dem get sense to kip dia gospel kampain witout say dem fail Oga God. Di skripture talk am say, “Dis matter kon kause sirious kworel, sotey dem kon separate. Banabas take Mark follow body and dem kon enter ship go Cyprus but Paul choose Silas and dem go meet di brodas and sistas kon pray make God bless dem. Paul pass thru Siria and Silisia dey enkourage di pipol wey dey di church dem for der.
LESSON
Christian brodas wey kom from different denominasons fit no agree on evritin wey dey practiced in Kristenity; but we fit still serve Oga God togeda. Dem kol us to serve God togeda, and we most do so witout say we listen to doktrine wey fit cause fight. Kristen komunity no go allow out opinions wey dey different to hurt di gospel wey Oga Jesus die for! We most to dey learn from Paul and Barnabas, who be savants for God place but get different opinions on some issues. Di two kon separate, but no be say di gospel go dey affected! Paul and Barnabas no allow make dia differences to stop dua relationship wit Oga God; dem treat dia differences wit maturity and dia ministries dey move (Acts 15:39-41). He dey noteworthy to talk say both Paul and Barnabas prospa for dia outreashes afta dey separate.
PRAYER
Oga God, abeg save di Kristen komunity from bitterness and anger of division wey do stop our operations. Let brodas dey deal wit diasef wit respect. Help us to dey find komon ground wey go offa us ground to dey preach yur gospel witout mago-mago. Help us to lay for one side our differences, and let us dey respect di bible teashing. Let yur Holy Spirit dey give us di propa meaning of yur world, and let us to dey apply dem to our lives. Help di church to dey sensitive and dey kooperate do krusade wey go show yur riteousness standard kon lead pipu to receive yur salvason. Let us be yur true ambassador on eart so dat we go fit receive yur life wey no dey finish rewods for heaven. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
