Offer Yur Gift Wit Heart Wey Pure
Oga God warn di Israelites make dem stop dey pretend,make dem kon dey walk well before him. Di kreator talk say di Israelites wan bribe am wit dia fat offerin while dem dey for sin. Jehovah talk say he no go accept dia offerin. Oga God tell di Israelites say make dem put dia riteousness above dia generous giving; dem most to relate wit him wit heart wey pure before he go fit accept dia gifts. Oga God talk say, “Wen una bring korn and burnt ofrin kom give mi, I nor go asept am; I nor go asept di animals wey una kill kon offa give mi as ofrin. Make una stop to make nois sey una dey sing;I nor won listin to una harp wey una dey play. Instead, make korrect judgement dey rush like river, while raitiousness go bi like river wey nor dey dry.” (Amos 5:22-24).
LESSON
Oga God no be man, and no fit det deceived ny gift of any size. Jehovah go only receive an offerin wey dey presented to him from pure heart. Before Oga God go accept an offerin, it most kom from heart wey pure, and witout say di giver wan kolet anitin back. So, since Oga God dey koncerned wit honest offerin, hin shidren most also do wetin he want. Shidren of Oga God most to dey sing song of praise kon dey offa our dance to God wit honest. No shaid of God most sakrifice hin resources to God bekos say he get wetin he wan kolet – since oga God no go dey satisfied. We most to dey give all praise and honor to Oga God witout say we kip anyone.
PRAYER
Oga Lord, how I fit serve yu well-well, and how I fit offa sakrifice wey dey acceptable to yu? I don know say yu no fit dey received wit gift wey no get honor – no mata how big he dey! Abeg help me to dey serve yu witout say I wan get sumtin back. Let me dey sincere wit my gifts, and let dem kom from heart wey pure. Let my sakrifice of thanksgiving dey satisfy yu, and help me to dey maintain konsistent service to yu, so dat I go fit qualify to receive yur blessin. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
