Satanic Activities Will Not Last Forever
Di antichrist operations of sinful kingdoms against God saints no go last eternally. God go put an end to those activities and haul di wicked pipu to hell fire. Therefore, God saints go celebrate dea victory and glorify God. Di bible state am, “Then a voice come from di throne, say, “Praise our God, all you Hin servants and those weh fear Am, both small and great!” And i hear, as e be, great multitude voice, as sound of many waters and as sound of mighty thunderings, say, “Alleluia! Fo di Lord God Omnipotent reign! Let us be glad and rejoice and give Am glory, fo di marriage of the Lamb don come, and Hin wife don make herself ready” (Revelation 19:5-7).
LESSON
All kristians bin encouraged to endure any persecution weh they may encounter, since dem go reap God rewards fo di end. Satan attacks against believers fit be harsh and brutal but dem no go last forever! Dem go soon fade away. God go halt all enemy' activities and cast evil doers to hell fire. Therefore, God pikin must dey happy and dey hopeful sey dea joy dey around di corner. To remain steadfast, we must dey pray to God daily and yield ourselves to di leadership of Hin Holy Spirit.
PRAYER
Dear God, i beg make your Holy Spirit keep my feet firm in you. Give me strength to resist temptations and triumph in all situations. Make your Holy Spirit help me live a konquerable life fo earth so that i fit rejoice with you fo heaven. Fo in Oga Jesus Krist name i make my requests. Amen.
