You Are Not An Ordinary Person
Nehemiah successfully lead hin pipu (Israelites) to rebuild Jerusalem wall despite di oppositions weh dem suffer from Sanballat and Tobiah. Di man of God and hin pipu accomplish dea mission, and celebrate dea achievement also. Di bible report am, “Now fo di dedication of di Jerusalem wall dem sought out di Levites fo all dea place, to bring dem to Jerusalem to celebrate di dedication with gladness, both with thanksgivings and singing, with cymbals and string instruments and harps” (Nehemiah 12:27).
LESSON
Nothing go be impossible fo kristians weh dey determine to faithfully serve God. Jehovah go support dem against dea obstacles, and help dem succeed. E dey important sey believers must understand sey we no bi ordinary pipu. We are pipu weh God anoint to get success fo earth. God dey our side, and he go help us prosper fo all our way. Nothing go be impossible fo person weh hin' trust reserve inside God!
PRAYER
Dear God, i beg help me to realize my status as God pikin weh bin born to succeed fo earth. Help me take faith step to achieve great things fo you! Bless my works so that i fit share your goodness testimoney to all pipu around me. I beg make my testimony of your goodness abide! Fo in Oga Jesus Krist name i make my requests. Amen.
