God Go Remain Our Sure Refuge
David see problem and kon kry to God say make He help am. He ondastand say na only God get enough pawa to deliva am patapata. David pray say, “My Oga God, make You help mi! Make You safe mi, bikos of your love wey nor dey fail. Make dem si sey, dis na wetin You do kon know sey na You bi my God, do am by yorsef. Make dem curse mi if dem like, bikos I know sey Yu go bless mi! Wen dem attack mi, na disgrace go follow dem! But mi, your savant go always dey happy! Make disgrace follow pipu wey dey akuiz mi; make shame kover dem like klot.” (Psalm 109:26-29).
LESSON
God na strong refuge in time of need; he go provide and protect Hin shidren wey kry fo help. No mata how hard di battle dey, God go bring am onda hin kontrol. He go turn kurse to blessin, and He go turn oppression to promotions. On di oda hand, shidren of God must to dey active fo dea prayer and trust God, so dem go enjoy Hin full benefits well-well.
PRAYER
Oga God, I ondastand say you be kova fo pipu wey kip dea trust in you. Now, I kol on you say make you defend my interest against di wish of di enemis. Ovacome my enemis, con give me pawa ova dem. Make Satan and all hin agents fall evritin wey dem dey think. On di oda hand, I dey ask you to bless me pass wetin pesin fit think of. Make me live evriday of my life fo victory. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
