God Kreated Us In His Image
We human being no be di only tin God kreate, and na we fine con get pawa pass for evritin wey God kreate. God kreate angels wey get pawa wey we fit fight. On di oda hand, even say di pawa wey we get get hin bus-stop, God still make us get beta honor pass di angels and oda kreatures. In fact, David s student how God take kreate human being, he con say, “My God, na who wi bi wey Yu dey kare for us like dis? Na ordinary human being Yu dey kare for so? Wi just bi like air wey dem dey breath; Awa days bi like shadow wey dey fade go.” (Psalm 144:3-4). David tok am again say, “Wen I look di sky for nite kon si di work wey Yu do; di moon and di stars wey Yu keep for dia place, I dey ask mysef, “Wetin pipol bi wey Yu dey tink about dem? Na ordinary human being Yu dey kare about?” Yu make dem bi like Yu kon give dem glory and honor. Yu sey make dem kare for evritin wey Yu kreate, bikos Yu put evritin under dia kontrol; all di animals, both wiked and di ones wey nor wiked, di birds for di sky, di fish for sea and evritin wey dey swim for wota. Oga awa God, Yor greatness full di whole world!” (Psalm 8:3-9).
LESSON
Na human being get level pass for evritin wey God kreate. God wey be di kreator of evritin make humans to look like himsef. While God tok am wit hin mouth say make oda kreatures dey exist, he wok to kreate human being. Oga God God bend down con use hin hand to mold clay to form man head,arms, nose, and oda body. He also lie down klose to di ground so he go breath life to the man . Man kon come to life, and he con be like God! On di oda hand, God also share hin dominion wit man wey he kreate, and he kommand him make dey kontrol oda kreatures. Shey God no dey wondaful to man and hin pikin wey dey kome nii? Gid don do beta tins for man and hin pikin wey dey come, and evrione most to dey appreciate am. God don show his special love to us, and we sopos to dey grateful to him! All pipol most to dey praise God bekos say he don choose us to be humans beings, no be animals! Since God don honor us laidis, we most to honor him too. Evri human being most to dey thank God for whom he/she be.
PRAYER
Oga God, I thank yu bekos say u kreate me a human being. I ondastand say u fit kreate me as chicken, and pesin go fit don chop me for food. Yu no make me fish wey anoda pesin go dey porsu to chop. Yu kreated me ae a human being, u con dekorate me wit grace, beauty, and honor. I most tok am say yu be a wondaful kreator! I love yu so mush, and I appreciate yur woks. Now, I go spend di rest of my life dey thank yu. I go praise yu for morning, and for evening. No be only dat, I go serve yu well-well onto di end. Na for Oga Jesus Christ name I beg all dis. Amen.
