Pray For Leaders In Nations
Kristians dey require to dey pray fo one another, and also dey pray fo di government leaders. E dey written,
“Therefore I exhort first of all say supplications, prayers, intercessions, and to dey give thanks nah fo all men e make am fo, fo kings and all di pipu weh dey in authority, sey we fit lead quiet and peaceable life in all godliness and reverence. Fo dis one good and e dey acceptable fo di sight of God our Savior, weh desires all men to be safe and to come to di knowledge of di truth” (1 Timothy 2:1-4).
LESSON:
Kristians are to pray fo government officials since dem make decisions weh dey affect our lives. Make we pray fo dem to get kontrite heart to make good decisions weh go positively impact our society. More important, male we pray fo our political leaders to believe God and serve Am - since godly fear leads to wisdom (Proverbs 9:10), Believers suppose pray sey our leaders prioritize citizens' interests pass dea political ambitions. Di spirit of selfishness and corruption must to be subdue fo di lives of our leaders - through prayers! God go answer prayers, and He go answer us. God go use our prayers to initiate a change weh go stir our society fo di right direction. With God fo our sides, our streets fit be saved again, and God righteous standard fit be uphold inside city halls.
PRAYER:
Dear God, i beg i pray fo our leaders to have your fear so that dem go make decisions weh go positively impact our live. Make our leaders get peace, clarity of mind, and ability to govern us appropriately. Make our leaders get integrity and pursue righteousness, so that our society fit get progress. I beg remove di spirit of self- kenteredness, arrogance, and korruption from our leaders. Make dem get godly konscience and integrity to takr lead our land to having abundant prosperity. Fo in Oga Jesus Krist name i make my requests. Amen.
