Signs Of End Time
Kristians suppose dey careful of false doctrine, and avoid dem. The bible warn,
“Now di Spirit expressly say in latter times some go depart from di faith, giving heed to deceiving spirits and doctrine of demon, dey speak lie in hypocrisy, having dea own konscience seared with hot iron, to dey forbid to marry, and kommand to abstain from food weh God create to receive with thanksgiving by those weh believe and know di truth” (1 Timothy 4:1-3).
LESSON:
This generation don witness many events and practice weh di bible don predicate to be signs weh go be fo End Time. “False Doctrine” nah one of di signs (Matthew 24). Believers don dey warned to dey sensitive to bible teachers, and ensure sey dem no derail. While e dey important to appreciate God servants, we must still dey kareful fo di teachings weh we dey receive. Believers must dey sensitive to dey comply with bible always. Our degraded society don prove sey some preachers, teachers, prophet, and others go appear to use subtle approach to deceive dea audience. In fact, bible warn sey some ministers go even perform miracles to manipulate people fo dea selfish gains, and haul pipu to hell fire. However, kristians must ensure to avoid pitfalls; dem must be bible student themselves. Believers must dey read dea bible on konsistent basis, and allow di Holy Spirit to give dem godly interpretations. A good kristian must validate any teaching weh he/she receives with di bible! All believers must ensure to dey fo di right track and stand upright with God in order to make am to heaven.
PRAYER:
Dear God, i beg help me to dey kareful not to allow false teachings. Help me to only entertain teachings weh comply with bible standard. Make you no make me become victim fo false teaching and miss opportunity to go heaven. Give me grace to dey study my bible daily to establish all truth, so that I fit meet you in heaven on last day. I beg keep my feet firm in faith, and count me worthy fo your eternal kingdom! Fo in Oga Jesus Krist name i make my requests. Amen.
