Trusting God No Go Be In Vain
Bad tins happun to David, but he still managed to show him konfidence in God. David dey very sure sey hin God dey strong to deliva him from hin wahala. Di man komposed a psalm, kon say, “I dey kwayet dey wait, bikos na God dey diliver mi. Na-im bi my Rock and Salvashon; di place where I dey hide put and I no go fear or shake. How long una go dey treaten one man? All of una dey kill pipu and una bi like wall wey don break or fence wey get mark wey go soon fall. Dem dey spend all dea time dey plan how dem go take finish mi. Dem dey happy to lie about mi. Dem dey praiz mi fo my present, but fo dea heart, dem dey curse mi. But my soul and body dey kwayet dey wait fo God, bikos na-im dey make my heart strong. Na-im bi my Rock and Salvashon; Di place wea I dey hide put and I nor go fear or shake. My viktory and honor dey kom from God. Na-im dey guide mi and na-im bi my Rock, so nobody fit kom attack mi fo der.” (Psalm 62:1-7).
LESSON
All kristen must learn to trust dea God fo difficult times. No shalenge must to stop us from trusting God, since notin dey beyond Hin reach. He dey strong and dey able to solve any problem – no mata how di problem big! On di oda hand, if we no trust God, who we wan trust? We no fit dey expect any miraku from our felow human being, since all humans fit do mistakes and get wetin where dea pawa reach. Belivas must dey trust God and dey ask fo Hin help since he get pawa wey plenti and He dey unbeatable! No mata how terrible a trial dey, he go still dey onda God pawa . So, everione who wan laugh ova Hin problem must to trust God.
PRAYER
God abeg, help me to dey defend my faith in you evritime. Help me make I get konfam faith, and make I dey trust you ova any shalenges wey go come my way. Give me victory: make me laugh, and make Satan dey ashamed Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
