Success Dey Wit God
King Solomon build a new temple and he dedicated am to God. He also kol hin pipu con pray fo dem. He dey reported say, “Afta Solomon don pray to God finish, e stand fo di altar front wea e knee down and raiz en hand since. Wen e stand up, e bless all di pipu as e shaut dey sey: “Make wi praiz God wey don give en pipu peace, just as E sey E go do. E don do all di tins wey E promise Moses En savant. Make di Oga wey bi awa God dey with us as E bin dey with awa grand-grand papa dem and make E nor leave or abandon us.”(1 Kings 8:54-57).
LESSON
God get pawa to help anybodi to get success. He go sopot anyone wey pursue a mission wit good purpose. Di kreator go do anytin and do pawaful tin fo a God-fearing pesin. In fact, dea go be no unachievable task fo di felow. Howeva, a pesin wey hin mind no pure may not prospa. If he/she prospa, he no go dey long. Success wey dey long and wey pesin fit inherit go get di fear of God.
PRAYER
God abeg, help me make I have good motive and pursue missions wey go bring blessins. Let wetin I dey think and my action make pipu lives beta. Also, let my effot dey glorify your name. Let me succeed in anitin wey I do, and give me pawa to share di testimony of your goodness to all di world. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
